DELTA STATE HOUSE OF ASSEMBLY SPEAKER IMPEACHED
RT. HON. MONDAY IGBUYA IMPEACHED,AS SPEAKER OF DELTA STATE HOUSE OF ASSEMBLY.
I nor want make anybody ask me wetin happen to Igbuya becos I dey vex and water dey commot from my eyes like this. I hate to hear bad news. Take it or leave it,as me dey vex say dem impeached Rt. Hon. Monday Igbuya,na so other groups for him own home town (sapele) de happy WHY?
My sister tell me not to cry again,say before Igbuya final elections,I try to convince people to vote for the Man,so that Sapele go get Speaker and good things go come Sapele,but since the man enter Government House as the number 3 Man of the State,e first refused to comply with e promises to all the groups,wey e beg to vote am into office,most especially SAPELE TAFIA forum wey e promise SA. If that is not enough, Sapele nor feel the impact of Speaker for two good years and hence the leaders and some Community Heads dey use Sapele growth do Politics.
I know say wetin Keneri dey talk na truth but as Sapele Otota1, I vex say Sapele lost this opportunity,becos I nor know wen Sapele go get this chance again.
As we speak it has been confirmed,say na another Okpe Man dem use replace Igbuya. As the honourable member representing Okpe State Constituency Hon Chief Sheriff Oborevwori nai dem make the new speaker of the Delta State House of Assembly.
Them say d impeachment was duly signed by 22 Lawmakers of the state house of Assembly.
I nor wan talk much this morning becos I dey vex,but make I ask the audience and followers of this forum weda the House Of Assembly do wrong for deir decision or not.

Comments